click banner for details

click banner for details

Thursday 12 December 2013

Girls Please Shine Your EYES This Christmas.....For Laughs But Might be True!






Girls, make una shine una eyes dis Christmas ooo.

1- Any guy with too many pictures and plenty story na from London (him no get shishi)

2- Any guy wey share knock-out and balloons na from China (he has just been released from jail and he's not going back) 

3- Any guy wey wear singlet everywhere he goes , na from Jamaica (no money for him hand, he just came back to smoke enuff naija Igbo and drink Ghana roots) 

4- Any guy wey wear kito slippers na from Togo or Cotonou (him no get money, him come back so dat him mama go help am borrow money from village meeting) 

5- Any guy wey tie head-tie or wear big combat short from morning to night everyday is from America (na as him go take sell the okrika wey full him luggage dey him head) 

6-The one wey wear ear-ring and every time wey u see am, na so so shaving powder him dey rob, (na deport dem deport am from South Africa) 

7-The one wey wear Jersey from morning to night, na from Germany (shishi dem no dey give person, but dem fit buy u beer)

8- Any guy wey carry plenty red money na from Angola (10,000 kwanza na 1 naira oo )

 
9- The one wey dey wear track-suit always na from Canada (na Bake beans full him luggage) 

10-  Anyone that carries gadgets like laptop, iphone and bb up and down na from Malaysia and e must sell all of dem by January to complete ticket money. 

You better Stay with ya own bobo oooo, to avoid had I known in January.............I don talk my own! " Take it easy"

No comments:

Post a Comment